
Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Rachel Looker
- Role, BBC News, Washington
-
US President Donald Trump don sack di Chairman of di Joint Chiefs of Staff CQ Brown, wey be di highest-ranking officer for di kontri.
Dis na part of di major shake-up of top military leadership wey Donald Trump dey do.
“I want to tank General Charles ‘CQ’ Brown for im ova 40 years of service to our kontri,” na wetin Trump post on social media. Im say im dey replace five oda top officers.
Gen Brown na di second black officer to hold di post, anybody wey dey di post na im dey advice di president and di secretary of defence about national security.
US Defence Secretary Pete Hegseth bin tok bifor say, make dem sack Gen Brown sake of im “woke” focus on diversity, equity and inclusion programmes for di military.
Later on Friday, Hegseth announce say dem don sack two additional senior officers: Chief of Naval Operations Adm Lisa Franchetti and Vice Chief of Staff of di Air Force Gen Jim Slife.
Adm Franchetti na di first woman to lead di US Navy.
Na former president, Joe Biden appoint all di three top officers wey chop sack on Friday.
Hegseth tok for statement say: “Under President Trump, we dey put in place new leadership wey go focus on our military and di core mission of deterring, fighting and winning wars.”
Trump tok say im go nominate Air Force Lt Gen Dan Caine – career F-16 pilot wey just recently serve as CIA associate director for military affairs – as di new chairman of di joint chiefs of staff.
Last year, for di Conservative Political Action Conference, Trump remember how e meet Gen Caine for Iraq. “He bin look beta dan any movie actor you fit get,” Trump tell di audience.
For di same speech, im bin praise di US military but say dem dey “woke at di top”.
Wia dis foto come from, Getty Images
Gen Brown bin dey visit troops for di southern US border on Friday, roughly two hours bifor Trump announce say im go comot from di position.
Rumours bin dey fly upandan dis week say di president fit remove di commander, wey im term suppose expire for 2027.
Gen Brown bin make headlines for 2020 wen im bin tok im mind about race afta di death of George Floyd.
Im bin post one video message to di US Air Force wey describe di pressures wey im bin dey feel as one of di few black men for im unit, including plenti questions dem bin ask am about about im credentials.
For 2022, chief of staff of di air force, Gen Brown co-sign one memo wey set out diversity goals to boost di proportion of minority officer applicants and try to adjust and lower di rate of white candidates, according to the Air Force Times.
Colin Powell na di first black chairman of di joint chiefs of staff, wey serve from 1989-1993.
One of Trump first acts afta dem swear am in last month, na to sack di first female commandant of di Coast Guard, as im say na sake of her “excessive focus” on diversity.
Wia dis foto come from, US Air Force
For November, bifor dem confam am, Hegseth tok for one podcast say plenti problems dey for di military, including diversity initiatives, wey di Trump administration suppose to “course correct”.
“First of all, you need to sack di chairman of joint chiefs,” Hegseth tok as im describe di steps im beliv say Trump suppose take.
Di Pentagon also announce on Friday say dem go cut dia budget and remove 5,400 employees wey dey on probation next week.
Meanwhile, one federal court for Maryland bin temporarily block Trump from implementing bans on diversity, equity and inclusion programmes.
District Judge Adam Abelson bin rule say directives by Trump fit violate free-speech rights for di US constitution.